Made my hair today. As we dey plait nai one other customer come dey call call the stylist.
Shuoooo..... the call don too much nai I ask the stylist wetin happen? She say the customer don already book her down before but she say make she rush do my hair.
Ok naa.... nai we begin to plan wetin we go tell the woman.
TRUST!!! Nai I pick the call turn my voice and accent to one strong warri woman own. "Madam abeg no vex, na you be the person wen ee wan com do ee head? Abeg ee boyfriend seive ee fone say ee must cook before ee comot for hase ooo. I be ee boyfriend sixter and na call them call me say faight dey, nai I run come oo. I don take d fone for my yeye broda hand now and she go dey come soon, abeg no vex.
Kai I be real Mercy Johnson improvised.
Ciaooo...
No comments:
Post a Comment